Galatasaray Striker, Victor Osimhen don yarn how one senior player for Nigeria national football team pursue am comot for room during im first call-up for 2017 under coach Gernot Rohr.
Osimhen tok dis one during one livestream chat with Carter Efe on Saturday morning.
According to am, di player bin dey share room with Kelechi Iheanacho.
E remember say as e come Uyo, I meet Iheanacho tell am say I wan carry im boot, so e tell me make I come im room.
When e reach, na di player open door and just bounce am, e no even gree make e enter.
Osimhen talk say Iheanacho later come out come face di player, say why e go pursue person wey come look for am.
E sti add say, Iheanacho come hold im hand drag am enter room.