By: Mariam Ajayi
Boxing fans don rush go buy off all di hotel rooms inside Cardiff town ahead of di December 12 fight between Anthony Joshua and Tyson Fury.
Papa Emeka, and Mummy Ife wey dey plan carry side chick and cock go for dirty December, abort plans, abort plans, Cardif don cast like dis.
Di Welsh capital don bring body out say dem go use dia Principality Stadium host di big heavyweight fight.
Now nobody dey tuk about di New York Madison Square Garden mata again for di fight.