south west

Gbajabiamila And Security Chiefs Meet Families Of Kidnapped Students, Share Tinubu Message

todayJune 1, 2026

Background
share close

By: Esther Ayoola

One heavy Federal Gornment team on Sunday don go visit Ogbomosho area for Oyo State to meet with community leaders and families of di teachers and students wey gunmen kidnap on May 15, 2026.

Di big-wigs inside di delegation join include di Chief of Staff to di Presido, Femi Gbajabiamila, National Security Adviser Nuhu Ribadu, Minister of Defence Christopher Musa, and di Inspector General of Police, Olatunji Disu.

Gbajabiamila naim deliver baba Seyi message give di community, as im tuk say oga presido,  dey feel dia pain and sorrow of di pipo.

Im come add say di Oga emilokan don order all security agencies make dem do everything to bring everybody back home safely.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds