By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don promise say dem go improve on consumer protection because of plenty bad goods and services wey dey enter di Lagos market.
Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu tuk dis one yesterday for World Consumer Rights Day wey dem dey call “Safe Products, Confident Consumers.”
E press tuk say pipo dey lose billions of naira every year from fake medicine, defective goods, and misleading adverts.
Sanwo-Olu, wey Attorney General Lawal Pedro represent, say, di biggest problem na online business, say na dem dey make am easy for banned or bad products reach pipo, so protecting Nigerians don become emergency.