Lagos

Governor Sanwo-olu Go Commission 36 Schools For Tolu Complex

todayApril 9, 2026 2

Background
share close

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, go commission di Tolu Schools Complex for Ajegunle area of di state on Thursday.

Di Tolu Schools Complex dey get 36 public schools, 31 secondary and 5 primary schools wey dey for Ajegunle inside Ajeromi-Ifelodun Local Government Area of Lagos State.

Di Tolu Schools Complex get standard football pitch with race tracks, multipurpose sport court for outdoor games, fire service station, health centre, water harvester, biodigester, and solar panels for di school to make sure power no cut.

To deliver big project like dis for area wey get about 20,000 pupils show say Lagos gornment dey focus on pipo well well.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app