For Mexico, say one gunman open fire for Teotihuacan archaeological site for central Mexico, kpai one Canadian tourist and wound six other pipo, including visitors for Pyramid of di Moon area.
Security official tuk say afta di attack, di gunman sti take im own life for di same site wey di tourists dey climb to see ancient pyramids.
Authorities confirm say di wounded victims, dem don carry dem go hospital, including one Canadian woman, one Colombian woman and her pikin, one Brazilian, plus two Americans.
Dem sti dey investigate di reason behind di attack for di heavily visited tourist destination wey dey known for pre-Aztec pyramids.