south west

Gunmen Kidnap Ifedayo Local Government Vice Chairmo For Osun

todayJune 10, 2026 14

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Problem dem say e nor dey finish, dad some jaguda boys don sti go kidnap the Vice Chairmo of Ifedayo Local Government Area, Debo Farounbi, attacking Ora community along Osun and Kwara boundary on Tuesday night.

Di bad boys storm di area around 10pm, scata bullet for air, cause serious fear before dem bundle the chairmo and three other pipo face bush.

According to tatafo pipo, say na Military men and local rugged mehn naim rascal dis bad boys before dem run , dem abandon three of the victims wey include two Fulani women.

Residents confirm on Wednesday say the attackers manage escape with only the Vice Chairmo after one hot exchange of bullets with the security forces.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds