obodo oyinbo

Heavy Crucifix Pull Off Wall, Kpai Catholic Priest

todayOctober 19, 2026 5

Background
share close

Wonders dem say e nor get end, na so Catholic priest, Father Patricio Sánchez Molinari, take kpeme for Ecuador, nor be small village pipo doings, say one heavy wooden cross  fall untop am as hin  dey celebrate Mass for Our Lady of Perpetual Help Church for Guayaquil, Ecuador.

Dis sad incident hapun on Saturday during one service signature, and di whole thing show live as e dey hapun on top social media.

According by reports from Associated Press and El Universo newspaper on Sunday, di big crucifix just pull comot untop altar wia dem hang  am, fall for Priest head gboa, before pipo shout chinekele, otilor.

Pipo for di church try to rush am go hospital, but local news report say Father Sánchez kpai from di wunjurywey  e sustain from di hit.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds