Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
House of Representatives for Abuja don pass di 2026 Appropriation Bill wey go spend N68.3 trillion.
According to House Leader Prof. Julius Ihonvbere, say dis budget go favour development more dan consumption and make capital spending pass recurrent spending for di first time.
U sabi say, di approved budget, wey Presido Bola Tinubu propose last year, include over N26 trillion for roads, power, and other projects, N5.4 trillion for security, and N15.9 trillion to pay debt.
Speaker of di House, Rt. Hon. Tajudeen Abbas, add say lawmakers follow korrect process, pass am on time so dat Nigeria fit keep di January-to-December budget cycle.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026