Nigeria

54 Results / Page 1 of 6

Background

OBODO NAIJA

Atiku Drag Tinubu Govment As Things Dey For Naija

Former Vice Presido Atiku Abubakar, don scata table again oh drop hin mouth odour, drag wi baba presido,  criticise Presido Bola Tinubu over high cost of living and insecurity wey dey make life hard for Nigerians. E tok dis one for im X page on Wednesday,  say na only wicked leader go pretend like say hin understand suffer. Atiku, wey be ADC presidential candidate, say plenty families nor fit afford […]

todayOctober 14, 2026 5

OBODO NAIJA

 Presido Tinubu Assure Nigerians Say Nigeria Dey Move From Reform To Prosperity

  Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don konfamate to Nigerians say di series of economic reforms wey government introduce go surely bring better days. Tinubu give di assurance for im address to di nation on Thursday, October 1, as Nigeria dey celebrate 66th Independence Day. Tinubu say di reforms no weaken di economy as many pipu believe, and e assure Nigerians say di promises wey e make dem dey […]

todayOctober 1, 2026 16

OBODO NAIJA

NLC Tell Gornment Say Make Dem Bring Fuel Price Down

Nigeria Labour Congress, NLC, don call on gornment to reduce petrol price, pay workers nationwide wage award and start fresh toks on new minimum wage, as Nigerians dey struggle to survive under high cost of living. For Independence Day statement wey dia Presido, Joe Ajaero, sign on Wednesday, di union tok say workers and ordinary Nigerians don dey suffer under high transport fare, food price, house rent and school fees. […]

todayOctober 1, 2026 9

OBODO NAIJA

US Praise Nigeria Response To Plateau Attacks

By: Mariam Ajayi United States don praise Nigeria response to recent attacks for di Middle Belt, as America urge Federal Gornment make e continue to protect communities for Plateau State. US Department of State Bureau of African Affairs make di call for X on Tuesday, as e praise Nigeria response to di latest attacks wey e attribute to Fulani militant groups. Di US gornment say dem go continue to work […]

todaySeptember 29, 2026 13

OBODO NAIJA

US, Nigeria Move To Strengthen Security With 12 New Helicopters

By: Mariam Ajayi America and Naija don dey push dia security cooperation forward, as Naija plan to buy 12 AH-1Z Viper helicopters to boost di country defence power. US Mission for Naija reveal dis one for dia official X account on Tuesday, as e describe di planned purchase as part of di efforts wey both countries dey make to tackle current and new security threats. Di mission say America value […]

todaySeptember 29, 2026 10

Politics

Obasanjo Tok Say Nigeria Help End Apartheid for South Africa

By: Kofoworola Olayinka Former Presido Olusegun Obasanjo don say South Africa for struggle to end apartheid without Nigeria strong support during di gbas gbos against white minority rule. Obasanjo tok am while speaking on Naija role in di anti-apartheid struggle, saying Naija oppose di system because dem believe say no Black person suppose dey treated like inferior human being. E say  make Naija join hands with other African leaders to […]

todaySeptember 14, 2026 14

OBODO NAIJA

Charly Boy Say No Mistake Obasanjo Laughter For Weakness

By: Mariam Ajayi Popular Nigerian entertainer, Charly Boy, don warn Nigerians say make dem no mistake former Presido Olusegun Obasanjo laughter for weakness. Charly Boy say Obasanjo no be person wey anybody suppose mess with, as e describe di former presido as fearless. For post wey e make for X, Charly Boy compare himself with Obasanjo and say both of dem dey make am laugh sometimes.

todayAugust 26, 2026 16

OBODO NAIJA

Naija Begin Send Onion Give Ghana

By: Mariam Ajayi Nigeria don lift suspension on onion exports to Ghana, clearing di way for immediate resumption of cross-border onion trade between both country. Di National Onion Producer, Processor and Marketer Association of Nigeria say di decision follow consultation with trade pipo, diplomatic authority, ECOWAS and other stakeholder. NOPPMAN President, Alhaji Aliyu Isah Maitasamu, na im announce di decision for public notice dated August 19, 2026. Di association say […]

todayAugust 19, 2026 17

crime& security

NDLEA Bust Cocaine Cartel, Arrest ‘KC Luxury’ As E Try Run From Nigeria

By: Kofoworola Olayinka NDLEA don bust one international cocaine cartel wey allegedly dey use Nigeria as road  to move illegal drugs go UK, Europe and Asia. According to report say dem  arrest di alleged Nigerian leader of di group, social media influencer Afolabi Kazeem Michael, aka KC Luxury. NDLEA Chairman, Brigadier General Mohamed Buba Marwa, yarn dis one for Lagos on Tuesday, Di agency say e arrest am as e […]

todayAugust 19, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds