Sports

How 2026 World Cup New Rules Fit Benefit Football

todayMay 25, 2026 4

Background
share close

O boy, see as di matter be, di 2026 World Cup wey dey come so, no be small thing o.

FIFA don change di game rules kpatakpata to make sure say football sweet, e fast, and everything move correct.

Di countdown for football history don enter final stage, e remain just 20 days make ball start to roll for June 11, 2026.

Dis World Cup fit change di way wey dem dey play ball for di whole world, as dem increase di teams from 32 go 48, and Canada, Mexico, plus USA go join bodi host am.

As qualifiers and play-offs don finish for March 2026, all di 48 countries don set for their 12 groups and dis 45-day tournament go feature 104 matches wey go long pass di Qatar 2022 edition with five days, because teams plenty now, countries like Uzbekistan, Cape Verde, Curaçao, and Jordan go show their face for World Cup for di first time ever.

But as di teams go play one extra match before dem reach final, FIFA and IFAB don bring out serious new rules to stop time-wasting and make di game move fast.

Na di new rules wey you go see be dis:

 

1. No More Time-Wasting (5-Second Rule)
Referee go dey count 5 seconds for any player wey wan throw-in. If you waste time, dem go carry di ball giv di other team sharp-sharp. If goalkeeper con waste pass 5 seconds to play goal kick, the other team go collobi corner kick. so no more dull moment.

 

2. Timed Substitution
Any player wey dem sub out get exactly 10 seconds to comot field. If you dey waka like say you dey stroll, your team go suffer am. Di new player wey suppose enter go wait for sideline for 1 full minute before e enter, meaning say your team go play one man-down for 60 seconds.

 

 

3. VAR Don Get More Power
VAR now fit check things wey dem no dey check before:

Second Yellow Card: If referee give person second yellow (wey mean red card) by mistake, VAR fit talk say “No, that one no reach.”

Wrong Corner Kick: If team score from corner wey suppose be goal kick, VAR go cancel di goal, kon restart am again.

 

 

4. Body Cameras for Referees
To make sure say everybody dey see wetin dey happen and to protect referees, dem go wear small body cameras. Dis one go record both video and audio of everything wey di official dey see and hear for inside match.

 

 

5. “Captain Only” Protocol
Football no be market where everybody go dey surround referee dey shout. Na only Team Captain get right to follow referee talk. Any other player wey run go there go collobi automatic yellow card beta style.

 

 

6. Double Yellow Card Amnesty
Dem don shift di “clean slate” (where yellow cards go disappear) reach end of group stage and quarterfinals. Dis one na to make sure say star players no go miss big matches like semifinal just because of one small yellow card.

 

 

7. Medical Treatment Delay
If player fall down talk say e get injury just to break di flow of di other team, e must stay outside for 1 full minute after treatment before e enter back. Di only way e fit enter immediately na if di foul wey reach him body make di other player collect yellow or red card.

 

 

 

8. 5-Substitution Rule
Teams fit change 5 players for three different times (halftime no follow). If di match enter extra time, dem fit change di 6th person.

 

All these new rules na to stop wahala, restore referee authority, and make sure say mistake no go spoil game for anybody. FIFA dey try make football evolve, some people fit talk say di game don change too much, but di truth be say, di era of tactical delays and technical huddles don finish. As di 48 nations dey ready, dem no just dey play for trophy, dem dey play for a faster, fairer, and “no-nonsense” version of di beautiful game of football.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds