FIFA World Cup 2026

12 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

CAF Hail Africa Teams for Historic World Cup Performance

By: Esther Daniel CAF President, Dr Patrice Motsepe, don praise di performance of African national teams for FIFA World Cup 2026, say di continent achieve historic success and football for Africa dey grow well. For statement wey CAF release on Wednesday, Motsepe say out of di 10 African countries wey play for di expanded 48-team tournament, nine qualify from di group stage enter Round of 32. According to am, dis […]

todayJuly 22, 2026 16

obodo oyinbo

Trump Knock Tuchel Over England World Cup Exit

By: Esther Daniel US President Donald Trump don condem England coach Thomas Tuchel over di team 2-1 loss to Argentina for di 2026 FIFA World Cup semi-final. Trump say Tuchel make big  mistake wey im move captain Harry Kane into a defensive role after England score first. According to am, di decision give Argentina chance to take over di game and score two late goals to qualify for di final […]

todayJuly 20, 2026 14 2

Sport Yarns

Spain Shock France, Enter World Cup Final

By : Jolayemi Olajide Spain don shock World Cup favourites, France, beating dem  2-kondo victory on Tuesday to book dia place for the final of di tournament. Mikel Oyarzabal first-half penalty and Pedro Porro second-half goal naim hellep di European champions secure the win for AT&T Stadium, Texas. Spain, wey win the World Cup for 2010, go now face either Argentina or England for Sunday final in New Jersey.

todayJuly 15, 2026 8

Sports

Cape Verde Ready For Messi And Argentina World Cup War

Today, Africa world cup new comers,  Cabo Verde don rake full newspaper say dem nor dey fear anything, say dem go follow up defending champions Argentina  for Miami as both teams battle for place in di World Cup last 16. Cabo Verde, wey be di smallest country to ever reach di knockout stage, don surprise many people after dem draw  Spain and qualify ahead of Uruguay and Saudi Arabia. Argentina, […]

todayJuly 3, 2026 14

Sports

England check body say dem Nor Go Underrate DR Congo

Unto world cup update, England go face DR Congo on Wednesday for World Cup Round of 32 as dem dey fight to qualify for last 16. England coach Thomas Tuchel warn say make im players no underrate DR Congo, even though England na di favourites, inside dis competition big teams don see shege banza. England go depend on Jude Bellingham and Harry Kane to deliver, but defender Reece James no […]

todayJuly 1, 2026 9

Sport Yarns

FIFA Boss Infantino Face Media to address world cup Ticket Prices

By : Jolayemi Olajide FIFA Presido, Gianni Infantino go face journalists inside Mexico City on Wednesday because of high ticket price and immigration drama wey dey disturb World Cup start. Di football chief dey fry mouth to clear di US security blocking one top referee, fans, and officials not to enter dia country for di tournament. Infantino set dis urgent press tuk as co-host Mexico prepare to face South Africa […]

todayJune 10, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Drag US Over World Cup Ticket Wahala

By : Jolayemi Olajide Iran Football Federation don accuse United States say dem withdraw di World Cup tickets wey belong to Iranian fans just few days before di 2026 tournament start. Di federation say FIFA rules give every participating country 8 percent of match tickets, but dem suddenly collect Iran own allocation back after fans don already buy tickets and make travel plans. Dem also complain say visa wahala don […]

todayJune 9, 2026 12

Sports

How 2026 World Cup New Rules Fit Benefit Football

O boy, see as di matter be, di 2026 World Cup wey dey come so, no be small thing o. FIFA don change di game rules kpatakpata to make sure say football sweet, e fast, and everything move correct. Di countdown for football history don enter final stage, e remain just 20 days make ball start to roll for June 11, 2026. Dis World Cup fit change di way wey […]

todayMay 25, 2026 37 5

obodo oyinbo

Iran Send Dia World Cup Team Off With Loud Ceremony For Tehran Square

By : Jolayemi Olajide Iran don hold big send-off ceremony on Wednesday for dia national football team as dem dey prepare go play for 2026 World Cup wey go happen for USA, Mexico and Canada. Players wear red and black tracksuit as plenty fans gather for Enghelab Square for Tehran dey cheer dem, while coach Amir Ghalenoei and football federation president Mehdi Taj join the event. According to Taj, the […]

todayMay 14, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds