By: Yusuf Abuh
Di Lagos State Police Command don Konfamate di death of one 23-year-old Nigerian Law School student, Faith Alayande, after she allegedly jump from di rooftop of one four-storey hostel for her school campus for Victoria Island.
Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi konfam say dis mata sef reach dia office on Friday.
She say di hostel head woman, report di case and explain say another student and one relative see note a wey Faith write, before dem begin search for her.
According to di police, before dem fit locate her, she don already jump kpai herself, and wetin really make her commit suicide never really enter public.