Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
For Ghana, say Premier League footballer Dominic Frimpong kpai afta armed robbers attack dia team bus on Sunday night as di team dey come back from away match for Ashanti Region.
Di club Berekum Chelsea FC naim konfamate dis mata, say masked men wey carry guns and assault rifle open fire for di team bus, na so players scata.
Ghana Police Service tuk say di incident hapun around 10:30pm for Ahyiresu-Kwame Dwumor Sreso road for Nyinahin District, and dem rush Frimpong go hospital afta he collect bullet wound.
Police add say di reason for di attack , say na armed robbers attack di team, and even though di player reach hospital, Frimpong sti kpai because of di wunjuries.
Written by: News Author
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026