Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Registrar for Joint Admissions and Matriculation Board, Ishaq Oloyede, don clear matas say di ongoing Unified Tertiary Matriculation Examination waka well for most parts of Nigeria.
He yarn dis one for University of Ibadan CBT centre during im monitoring visit for Oyo State.
According to am, na only small wahala like light issue and minor technical faults naim dem see for about 16 centres out of di nearly 980 nationwide.
He still add say dem don successfully conduct exam for over 1.7 million candidates within just three days, showing say di exercise largely succeed.
Written by: News Author
JAMB 2026 JAMB Monitoring 2026 JAMB Updates Oyo State news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026