By: Esther Ayoola
Say nor be small tin sup For Gaza on Sunday, dat Israeli attack kpai at least eight Palestinians, including three pipo wey dey work for community kitchen for Deir el-Balah.
Reports tuk say di attack for Deir el-Balah, target di community kitchen workers.
Hamas react say, di attack na war crime and dem accuse Israel say dem dey target civilians and groups.
According to Gaza Health Ministry, say na over 72,760 Palestinians naim don kpai since October 7, 2023, while Israeli military sti dey control about 60% of Gaza territory.