General

How Kidnappers Dey Target Victims Through Social Media

todayJune 9, 2026 6

Background
share close

For old days, if kidnappers wan pick person, dem go need informant, follow person physically, or get insider wey know di victim well well. But nowadays, things don change.

Na so-called “harmless” social media post don turn their biggest tool. Plenty criminals no even need stress again, na victims dey give dem full informate like gift.

Security experts don warn say kidnappers and other criminals now dey use Facebook, Instagram, TikTok, Snapchat, WhatsApp Status and other platforms take monitor pipo, study dem, and pick possible targets. Cybersecurity experts like Loveth Odozor don also talk say criminals dey use online tracking and digital surveillance to identify victims. We go tell you how all this jaguda boys dey run their parrol on social media.

Oversharing Everything : This one na the biggest wahala, pipo go just dey post anyhow, some go post “Just land Abuja”, “Vacation mode activated”, “Family don travel go abroad”, “Nobody dey house for one week”. Before you know am, you don already tell stranger say your house empty, your movement clear, and your location open. Na so kidnappers dey gather informate without even asking you.

Flashing Wealth Online: Some pipo don turn social media into luxury showroom as dem dey always post cash pictures, expensive cars, new houses, designer lifestyle. To you, e na content, but to kidnappers, e be signal say “this person fit pay serious ransom.”Security experts don warn say anything you show online fit help criminals decide who dem go target.

Fake Accounts Everywhere: Another method na fake profile, dem fit use fine picture, pretend say dem be old friend, business partner, church member, or even fan, once you reply, dem start small talk, then begin collect information slowly, before you know, you don already open door for stranger enter your private life.

Social Media don turn to farm wey criminals dey harvest victims sake of say pipo dey do half di work for criminals. One picture fit show location, one status fit show travel plan, one video fit reveal lifestyle. one comment fit expose family structure. When dem put all together, na complete “victim profile” be that. Security experts describe am as criminals using personal information wey people freely post online.

If you wan protect yourself, no post your live location anyhow, no announce travel before you go, tighten your privacy settings, dey careful with friend requests, no overshare family detail, teach children online safety, turn off location tracking, think twice before you post anything.

Social media no be di main wahala , di real wahala na how pipo dey expose their life anyhow because every post na footprint, every update na signal.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds