Edited By Ebi Oboko
One Lagos resident , Ademola Oloyede, cry wetin nor gud explain how flood take carry im six-year-old daughter, Asabi, during heavy rainfall for Okeleye, Charity area of Lagos State.
According to am, di rain start on June 28 and later turn to serious flood wey break church fence before water rush enter dia compound.
Oloyede say im dey work when dem call am, but by di time e reach house, flood water don reach im chest and di pikin don already kpai.
Residents later struggle rescue people through rooftop as di flood suddenly cover di area.