Lagos State Police Command don do small ji mike gbab 26 fine-boys and fine-girls from other countries including some camerounians wey con fake dia kidnap.
According to di police, na one 22-year-old Cameroonian woman carry report go police station say dem kidnap am, afta she travel come Nigeria to see one 39-year-old Chadian man wey she dey date for internet.
But as police start to dig di dig, ehn, dem come see say di babe lie big lie from di pit of hell.
Now, di Lagos Police Commissioner,Fatai Tijani, don order say make dem transfer all di 26 suspects (19 Chadians and 7 Cameroonians) go State CID for Yaba so dat dem go explain demsleves.