By: Rilwan Agbomeji
US Presido Donald Trump don confirm say America strike one docking facility for Venezuela dis week.
Trump yarn dis one for Florida as e meet Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, say di attack na di first US military action for Venezuelan land for 2025.
According to Trump, di place na where boats wey dem believe dey carry drugs dey load, and di strike cause big explosion for di dock area.
Trump no give further details about di strike, but talk say di facility don completely scatter.