By: Yusuf Abuh
Ondo State Police Command don kramp one man wey dem dey call Amos Paul inside Owo on Thursday because he allegedly use hot iron burn him own 10-year-old daughter private part.
Di command tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, naim put dis for statement on Friday say di suspect do dis wickedness to punish di small pikin because she piss for bed.
Police detectives naim con go rescue di victim wey sustain heavy wounds, and dem don rush her go Federal Medical Centre, Owo, for urgent treatment.
As di suspect dey police cell now, di spokesperson yarn say dem don transfer di matter go Gender Unit for proper investigation to make sure say di papa face di full power of di law.