Lagos

Human Rights Group Vex For Demolitions As Lagos Gov Say ‘Make Dem Pause, Make We Reason First’

todaySeptember 10, 2025 1

Background
share close

Lagos Take It Back Movement don vex scatter over the house demolition wey dey happen for Oworonshoki inside Kosofe. Dem say the thing don throw thousands of families for street, no house, no food, nothing. Dem accuse Lagos State Government say dem just dump the same people wey dem swear say dem go protect. For one hot statement, the State Coordinator, Adekunle Adeyemi Taofeek, shout say make government stop all these demolitions sharp-sharp, and make dem hold and punish all the officials plus anybody wey join hand spoil people life. Taofeek talk say around 1:00 a.m. for Friday, September 6, 2025, heavily armed agents from Lagos State government enter Oworonshoki like thief in the night, begin pull down people house and chase residents comot. Many of dem still dey sleep with their families when wahala burst.

E say as some youths and community people try record wetin dey happen, dem fire teargas for their face, scatter everybody. “This one na pure government wahala wey dem plan for poor people head. Na state-sponsored terror be this,” na so e yarn. E still talk say this madness no start today, na same demolition wey dem don dey do since July 2023, and for that time, dem don already scatter over 1,000 houses and throw more than 30,000 people including women, children, and old people for street, with nothing to fall back on. “The plan clear like daylight, dem wan collect land from poor working people for Oworonshoki land wey their papa and grandpapa don hold, come dash am to rich people wey wan use am do business and chop profit. This kain bold land-grabbing show say Lagos State government, real estate moneybags, and even some traditional rulers don join body for this wickedness.” “Make we talk am clear, Governor Babajide Sanwo-Olu get blood for hand. This him government don show again say na rich people dem dey fight for, while poor man life no mean anything to dem. Which kain democracy be this wey go dey pursue people from their house for midnight, carry bulldozer break homes, and throw families for street?” The Movement talk say Lagos State must gree pay better money and find another place for all the families wey dem don scatter. Dem say all this grammar of “urban renewal” na just cover-up,  na land grabbing and wickedness wey dey push poor people comot for their own land. Dem no hide mouth: “Everybody get right to house, na basic human right be that. You no fit just wake one day begin render people homeless like say dem be animal.” “We no go just sidon dey look while dem dey turn Lagos people to refugees for inside their papa land. Take It Back Movement dey fully ground with Oworonshoki people and we go use every legal and democratic way to take fight this nonsense. We no go gree!”

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app