By: Rilwan Agbomeji
Former Super Eagles hitman, Odion Ighalo, don drop am hot say Victor Osimhen na di right man to wear Super Eagles captain band.
Dis talk come afta ex-captain, William Troost-Ekong, comot from international football.
Though many people dey shout Wilfred Ndidi name, Ighalo say Osimhen get di fire, form and liver to lead di team.
According to am, Osimhen dey ball well and no dey fear to demand wetin di team need, na why e fit carry captain job.