National

Ilorin Enter Mourning As Chief Imam Shaykh Solih Kpai For age 75

todayJanuary 19, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Di Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, don announce say di Chief Imam of Ilorin, Shaykh Muhammad Bashir Imam Solih, don kpai  early mormor at di age of 75.

Di Emir share dis report with tori pipo on Monday afternoon  say dem receive di news with total shock.

He describe di late Chief Imam as a man of wisdom, honesty, loyalty and strong dedication to Islam and di Ilorin Emirate.

According to am, di death don bring serious sadness and big loss to di entire Ilorin community.

 

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app