By: Esther Ayoola
Aba, INEC don rush go Court of Appeal for Abuja to tell dem say make dem throway dat judgment wey Federal High Court give on May 20.
Dis one dey happen afta Justice Muhammed Umar void di new rules wey INEC set, wey force political parties say make dem submit dia membership register by May 10 before dem fit join di 2027 election.
Na one political party wey dem dey call Youth Party take INEC go court, and di judge tuk say INEC no get power to shorten di time wey dey inside di Electoral Act 2026.
But for di fresh paper wey INEC lawyer, Alex Izinyon, file on May 25, di electoral body dey beg di appeal court make dem hold di judgment first before dem go look di mata finished.