National

Insecurity: ECOWAS Reject Religious Genocide Claims For Region

todayNovember 5, 2025

Background
share close

ECOWAS don come out yan say di talk wey dey claim say dem dey do religious genocide for West Africa na lie wey people dey use spoil peace and worsen insecurity for di region. Di regional bloc talk for im communique wey dem post for X say, “Di people wey dey do dis kain violence dey target innocent people of all religion, whether na Muslim, Christian or any oda religion. Independent reports don confirm say terrorist violence no dey look gender, religion, ethnicity or age before e attack.” Dem still call on UN and other partners make dem support di countries wey dey fight dis terrorist groups and make dem no believe any talk wey dey claim say one religion dey targeted or say genocide dey happen.

Di statement come after US President Donald Trump put Nigeria for Country of Particular Concern list over claims say Christians dey targeted for genocide. Trump yan say if Nigeria government no stop di wahala, dem go fit use military enter Nigeria, “guns-a-blazing,” to wipe out Islamic terrorists wey dey commit di atrocities. “I don tell our Department of War make dem ready for possible action. If we attack, e go fast, vicious, and sweet,” Trump talk. But Nigeria government don deny di claims, yan say dem dey committed to protect religious freedom for all citizens.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app