By: Esther Ayoola
Police for Lagos don do ogbonge waka gbab one businessman, Hammed Tajudeen Akanbi, wey dem accuse of kpaing Prince Ademola Akinloye and Sheriff Ishola Salami for separate attacks.
AIG Olohundare Moshood Jimoh naim yarn dis one for press briefing on Monday for Zone 2 headquarters, Onikan.
According to di AIG, na INTERPOL track and arrest Akanbi on April 15 for one hotel for Cotonou, Benin Republic, afta e run comot since police declare am wanted on February 19.
Police tuk say na over alleged land and community dispute naim make di suspect plan di killings and even send assassins go Ajiran community wia dem shoot di prince for cold blood.