LAGOS CRIME NEWS

9 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

Police Waka Lagos To Rascal One Chance Kidnappers

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police command don carry work for head dey do on di spot check to rascal all di rascalities for inside di obodo Lagos. Say dis waka na, Oga commissioner, Fatai Tijani naim lead di waka by imself on Tuesday for di city. According to di Commissioner, di Tuesday waka sef na based on complains from Lagosians about one chance motors, and how dem take […]

todayApril 22, 2026 14

Lagos

INTERPOL Catch Runaway Lagos Bizman Over Alleged Double Kpaing

By: Esther Ayoola Police for Lagos don do ogbonge waka gbab one businessman, Hammed Tajudeen Akanbi, wey dem accuse of kpaing Prince Ademola Akinloye and Sheriff Ishola Salami for separate attacks. AIG Olohundare Moshood Jimoh naim yarn dis one for press briefing on Monday for Zone 2 headquarters, Onikan. According to di AIG, na INTERPOL track and arrest Akanbi on April 15 for one hotel for Cotonou, Benin Republic, afta […]

todayApril 21, 2026 9

Lagos

Man Chop Life Jail After Sexual Assault On 6-Month-Old Pikin For Lagos Court

Justice Rahman Oshodi for Ikeja Sexual Offences and Domestic Violence Court don sentence one man, Victor Dickson, to life imprisonment, sake of say, e rape im neighbour 6-month-old pikin. Di judge tuk say prosecution show strong evidence wey prove di sexual assault case, pass reasonable doubt. Court also say, all di circumstantial evidence point directly to di convict, and im story no fit convince dig court. Justice Oshodi explain how […]

todayApril 14, 2026 11

Lagos

Lagos Police Command Kramp 3 Suspected Robbers, Recover Bike, Phones and Weapons

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area. According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use […]

todayApril 10, 2026 20

Lagos

iPhone Scam: Lagos Police Catch Woman for 500 Million Scam

By Ebi Oboko Lagos police command share update on wetin dey play for tech business for di obodo naija, say dem don arrest one 35-year-old woman, Modupeola Bamisade, for allegedly scamming over 100 people of more than N500 million. The Lagos State Police Command say she dey sell iPhones, iPads and other Apple products online, dey offer 50 per cent discount to attract customers. According to Police source on Wednesday, […]

todayJanuary 8, 2026 18

Lagos

Court Don Jail Eight People For Phone Theft For Lagos

Eight phone snatchers wey police catch for Mile 2 pedestrian bridge for Lagos State on Thursday don each collect six months jail sentence. State Commissioner for Ministry of Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, confirm di matter for im X handle. Di suspects dem, Anthony Osinachi, 21, Victor Onuoha, 45, Rowland Ede, 25, Daniel Chisom, 24; Emmanuel Chukwu, 35, Ogbonnaya Uchechi, 18, Godday Eke, 28, and Benjamin G, 30. Dem […]

todayNovember 14, 2025 14

Lagos

Robbers Shoot Lagos Hairstylist

One professional hairstylist wey dem identify as Sebastine Timothy don killed by suspected armed robbers for Satellite Town, Lagos State. Di incident happen on Sunday for Olasanoye Street area. According to one police source wey no wan mention im name, di victim return house after work, den robbers attack am, rob im of belongings and transfer money from im bank account, before shoot am for head. Di robbers run comot […]

todayNovember 13, 2025 23

Lagos

NURTW Member Don Scatter Dispatch Rider, Beat Am Till E Die

Lagos State Police Command don confirm say dem arrest one NURTW member wey dem call Shamsideen Adio, because e allegedly beat one dispatch rider kpafuka for Tapa Street, Lagos Island. Findings show say di wahala happen on Wednesday after Shamsideen Adio and di dispatch rider enter serious fight. im accuse di rider say e scratch Adio vehicle. Di matter come carry go violence. One journalist, Chris Nwandu, wey share video […]

todaySeptember 19, 2025 34 2

Lagos

Lagos Spare Parts Market Shooting Kill Six, Families Demand Justice Sharp Sharp

Death toll from di August 27 police shooting for Owode Onírin Spare Parts Market, Lagos don reach six now, and di families wey lose dia people dey shout for justice loud loud. Di mata happen when four Mobile Police, wey dem talk say one Abiodun Hakeem Ariori dey lead, enter the market with gbege, start shoot anyhow, kill four traders for road sharp sharp. After people begin vex well well, […]

todaySeptember 18, 2025 40

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds