By: Rilwan Agbomeji
Iran Foreign Minister Abbas Araghchi, once again don tuk oh, say Iran ready for war if America wan “test” dem.
Dis dey come afta US President Trump warn say im fit use military over Iran protests.
Protests start over money wahala but don grow to big calls for system change.
Ontop interview with tori pipo, E say tuk channels with US still open but Iran military strong pass before, dat dem nor dey legbere for anybodi.