Uncategorized

Israeli Airstrike Kpai 12 Pipo – Gaza Civil Defence Yarn

todayFebruary 15, 2026 3

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Israeli strike don kpai at least 12 pipo since early morning on Sunday, according to Gaza Civil Defence, as military official talk say dem respond to ceasefire violation.

Even though US-brokered truce wey enter second phase last month still dey on paper, fight never stop for Gaza, as Israel and Hamas dey blame each oda for breaking agreement.

Rescue team talk say one airstrike hit tent wey displaced pipo dey stay for Jabalia, as anoda strike hit land for Khan Yunis as bombing continue for Gaza City and Beit Lahia.

Al-Shifa Hospital and Nasser Hospital confirm say dem receive several dead bodi, as one resident cry out say Israel no dey respect ceasefire at all.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app