By: Esther Ayoola
Israeli forces don kill at least two Palestinians for Gaza strip as ceasefire no dey respected and humanitarian aid still dey blocked.
According to report, di two people die afta Israeli soldiers fire for Shujayea area, eastern part of Gaza city.
Dis bring total number of Palestinians wey don die for di past 24 hours reach 12, including eight wey dem comot from rubble.
Gaza government tuk say israel don break ceasefire 875 times since e start on October 10, and dem condemn di “serious and systematic violations.