By: Rilwan Agbomeji
Gunmen wey dem suspect say na bandits don kill six people for Tungan-Makeri and burn police station for Konkoso, both for Borgu Local Government Area of Niger State.
Di attack start around 8:00 p.m. Friday night when more than 200 armed men storm di village, dey shoot anyhow and set many houses on fire.
Residents tuk say di attackers operate for hours, kill six people and force many odas to run comot from dia homes.
One eyewitness from Zagatina village say e count about 41 motorcycles wey carry di gunmen, with two or three people for each bike, including some women and children.