By: Rilwan Agbomeji
Right now, na junior dey hot for basket ball , say dem climb nine places for di latest FIBA world ranking for girls, moving to 26 for world.
Di ranking wey come out for Thursday, show say Naija na di fourth biggest movers as dem jump from 30 to 26.
For Africa, Junior d’tigress dey for number three with 469.5 points, behind Mali wey dey 16th and Egypt wey climb go 21st.
For top of di table, United States still dey number one, as Spain and Canada follow for second and third place.