Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Former manager of music icon, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba and pikin of late legend Christy Essien-Igbokwe,, Kaka Igbokwe, don confirmate say di old trending video of 2Baba arrest for London after him quarrel with him pregnant wife, Natasha Osawaru, na true.
Recall, 2Baba travel go United Kingdom with him pregnant wife for concert tour, but him no show for di October 2, 2025 performance wey dem schedule for am.
As 2Baba no show, rumours begin fly say police arrest am after fight burst between am and him new wife, wey still be Edo State House of Assembly lawmaker, Natasha Osawaru, for airport.
But to confirm di mata, Kaka Igbokwe yarn for Daddy Freeze Instagram Live yesterday evening say, everything wey dey fly fly for social media about di couple fight na true.
Written by: News Author
2Baba London arrest Innocent Idibia news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025