National

Kano Gorment Advice Dia Youths Over Shameful Behaviour Before First Lady

todayApril 27, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Kano State Govo, Abba Yusuf don condemn di action of some youths wey reportedly show dirty character of giving underwear to women, during an official visit of Oluremi Tinubu for Kano State Naija.

For statement wey Govo Chief Press Secretary, Mustapha Muhammad release on Sunday, Yusuf tuk say di behaviour nor represent Kano culture at all.

E yarn dis one during Third Special Prayer for lasting peace for Gornment House, where 4,444 Qur’anic reciters gada pray for peace, stability and progress for Kano and Naija.

Di governor add say di act dey against Kano First Agenda and Islamic teaching wey support modesty, discipline and respect for authority, while e call on youths to behave well as future hope of di state.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds