OBODO NAIJA

Kelechi Anosike Blast Govo Alex Otti

todayJuly 2, 2026 7

Background
share close

Govonorship candidate for Peoples Democratic Party (PDP) for Abia 2027 guber race, Kelechi Anosike, don blast  Governor Alex Otti administration, say he no dey show workings at all for matter wey concern pipo welfare.

He fry mouth on top di matter for one press conference for Umuahia on Thursday, say many policies of di current government no dey touch di life of ordinary people for ground.

Di PDP candidate spoil face tuk say government dey focus on physical infrastructure too much and dem no dey look di face of common pipo for di state.

Anosike kon vow say if e win, e go look into di matter of di 10,000 civil servants wey dem sack before dem time, and e promise to fix di minimum wage palava.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds