Abia State

5 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Police Recover 28 Human Skulls, Bones From Camps For Abia

By: Mariam Ajayi Police for Abia State don recover 28 human skulls and different human bones from some camps for di state during security operation. Authorities say di recovery happun as security operatives dey raid di camps, while investigation dey continue to find out how di human remains take dey there. Police also dey work to identify di remains and establish di circumstances surrounding di discovery.

todaySeptember 29, 2026 8

Local

Otti Wife Give 400 Women With Disabilities N20m Support

By: Kofoworola Olayinka Abia Gofnor Wife Priscilla Otti don give N20 million and food items to 400 women wey dey live with disabilities for Umuahia on Friday. Otti, through her Safe Tent Care Initiative, say di support na to help women wey dey face financial hardship and make sure dem no dey left behind. She say her office don dey support people with disabilities since 2023, with plans to train […]

todaySeptember 11, 2026 13

OBODO NAIJA

Abia Pass Law To Regulate House Rent

By: Esther Daniel Abia State House of Assembly don pass law to regulate house rent and protect both tenants and landlords for di state. Speaker Emmanuel Emeruwa preside as lawmakers Augustine Okezie and Mandela Obasi sponsor di bill. Di new law come after plenty complaints from tenants for Umuahia and Aba over high rent and house agents wey dey inflate prices. Lawmakers also pass another law to help courts handle […]

todayAugust 5, 2026 24

OBODO NAIJA

Kelechi Anosike Blast Govo Alex Otti

Govonorship candidate for Peoples Democratic Party (PDP) for Abia 2027 guber race, Kelechi Anosike, don blast  Governor Alex Otti administration, say he no dey show workings at all for matter wey concern pipo welfare. He fry mouth on top di matter for one press conference for Umuahia on Thursday, say many policies of di current government no dey touch di life of ordinary people for ground. Di PDP candidate spoil […]

todayJuly 2, 2026 23

OBODO NAIJA

Abia Police Gbab Two Men Wey Pretend To Be NDLEA Officers

By: Emmanuel Ariyo-David Abia State Police Command don arrest two men wey dey accused of pretending to be NDLEA officers after one viral video show dem beating and handcuffing one keke rider for Umuahia. Detectives from Central Police Station for Umuahia arrest the suspects, Anthony Kelechi, 41, and Bright Abraham, 42, after investigation into the incident. Police spokesperson DSP Maureen Chinaka disclose this for statement wey she release on Wednesday. […]

todayJune 24, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds