OBODO NAIJA

Kwankwaso Condole With Jega As Im Wife, Hadiza, Pass Away

todayApril 6, 2026 4

Background
share close

Former Kano Govo, Rabiu Kwankwaso, don commot condolence give former INEC Chairman, Attahiru Jega, as im wife, Hadiza Jega, kpai on sunday.

For im Facebook post on Monday, Kwankwaso say Hadiza na woman wey get virtue and dignity, wey life don touch plenty pipo.

Im add say, her life na blessing not only to her family but to everybody wey she show kindness and strength.

Kwankwaso pray make Jega and im family get courage to bear di loss of dem beloved wife.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app