Real Madrid coachie Arbeloa don konfamate say, star boy, Kylian Mbappe go dey available for di Champions League clash with Bayern Munich on Tuesday.
For Pre match conference, Di Coachie explain say Mbappe na very important player for di team.
Mbappe wey be their top scorer nor start di last games against Manchester City because of knee injury, but di team still win wella.
Now wey e don recover, coach hint say Mbappe go likely play alongside Vinicius Junior for attack when dem face Bayern for Bernabeu.