Lagos

LAGESC Don Kick-Off 4-Day ‘Scale A’ Parade Exercise For Dem Operatives

todaySeptember 10, 2025 1

Background
share close

To make sure say all LAGESC operatives (wey people dey call KAI) dey sharp and ready for work, the agency kick off their Annual ‘Scale A’ Parade (head count) on Tuesday. This one go run for 4 days, and e serious to check how all the guys body dey strong and if dem fit do their work well-well. Na to sabi who ready and gats to carry their lawful work gidigba. The Corps Marshal, Major Olaniyi Olatunbosun Cole (rtd), yan dis one for Command Headquarters, Bolade-Oshodi. E talk say, “As we be oga patapata for environmental enforcement for this State, we dey rely on how our guys body and mind dey. Dis exercise dey help us check how dem dey physically and mentally, so we fit do wetin we gats do for dem. Since we start dis waka for 2024, e don dey bring better result, and we go still dey run am this year.” Cole tok strong on how important this exercise be as call to duty. E also yan say the State really dey care about every enforcement officer life, so dem must dey pay serious attention to their safety, health, and how dem fit handle their work well, to make tax payers proud. E talk say the exercise wey start Tuesday 6th May go finish Friday 9th May, and the flexible time make am easy for all the operatives wey dey scatter for different parts of the State.

The Corps Marshal remember how the ‘Scale A’ Parade wey start for 2024 don do correct work, helping the Agency create better file wey show how operatives for different parts of the State dey perform, so service fit improve well-well. E still talk say any operatives wey no fit well, dem go recommend dem make dem do medical check-up, counselling, and test, because all these tins dey help dem well well for recovery. The retired Army Major come still remind everybody say make all the Agency people serious for their work and responsibilities to the environment, the State, and Lagos people. E still hold ground say street trading wey dey show wares for road setbacks, lay-bys, kerbs, verges, medians, gutter slabs, and all dis kind places na illegal, because e dey spoil environment, especially when rain dey fall. For im last talk, e beg Lagos people to start dey do correct thing by dey throw waste only through approved PSP operators for the State, and make dem stop to support those cart pushers wey dey just dump rubbish for canal, because na that kind thing dey cause flood every rainy season.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app