Lagos

Lagos APC Go Start E-Registration For 20 Local Government Areas

todayDecember 29, 2025 10

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Lagos State APC don announce say dem go start electronic registration and revalidation for party members across di state.

Di e-registration exercise go run from January 5 reach January 28, 2026 for all 20 local govment areas of Lagos.

APC Lagos Chairman, Pastor Cornelius Ojelabi, talk dis one for end-of-year briefing with journalists for Lagos.

E talk say di move dey meant to strengthen di party structure and build correct, verifiable database ahead of future elections.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app