Lagos

Lagos Assembly Approve Deal For Ogbonge Waste Management

todayFebruary 17, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State House of Assembly don approve report wey four-man committee prepare on di deal to hellpe di state gorment proper waste management.

Untop sitting on Monday for state house Alausa, di committee tuk say, gornment  go share 4,250 tonnes from di 13,000 tonnes waste wey di state dey generate every day, so other investors fit join di waste management mata.

Committee wey Speaker Rt Hon Mudashiru Obasa lead, check di partnership wey suppose improve how di state go manage waste, before dem approve am.

Committee chairmo, Hon Gbolahan Yishawu, explain say, di House gatz approve di deal wey Govo Babajide Sanwo-Olu send and also check every, every untop di deal, say dis one sef go hellep bring proper waste management for di state.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app