By: Mariam Ajayi
Lagos State Commissioner of Police, CP Fatai Tijani, don call on Lagos pipo make dem stop to disrespect police wey dey road.
Dis one na to secure lives and property, as him say if police no dey road, fear go take over everywhere.
CP Tijani talk dis one on Monday, September 28, 2026, during press briefing with tori pipu for Lagos State Police Command headquarters for Ikeja, where he beg say make pipu dem respect officers wey dey carry out their duty and cooperate with them.
CP Tijani narrate how them take arrest one suspect wey kill one police officer on duty and that na why him say people dey look police officers on road less less and e no good.