Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
For Lagos state police command, commissioner of police, Tijani Fatai don order massive deployment of officers across di state to make sure say pipo dey safe before, during, and after easter celebration.
According to a statement released by police tuk tuk , Abimbola Adebisi, on Friday, say di police go station officers for churches, highways, parks, transport hubs and other important places to stop any wahala.
Dat dem go also send marine police go riverine areas while traffic control arrangements don set, an all na to make di easter segemenge.
Di CP urge residents, make dem stay alert, report any suspicious movement, and wish all christians peaceful and joyful easter.
Written by: Ridwan Agbomeji
COMMISSIONER OF POLICE Lagos state Tijani Fatai
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026