Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Lagos State Government don launch one big move to boost students’ entrepreneurship and digital sense to fight youth unemployment. Through di Ministry of Tertiary Education, dem go begin three-weekend Job Initiative Lagos (JIL) training for students from state-owned higher institutions. For di statement wey Director of Public Affairs, Mamud Hassan, and Commissioner Tolani Sule drop, dem talk say di training na part of Governor Babajide Sanwo-Olu T.H.E.M.E.S Plus agenda, wey focus on Education and Technology. Commissioner Sule yarn say di government wan use digital knowledge take push entrepreneurship, creativity and problem-solving skills among students, and di main target na to reduce unemployment and make Lagos remain di tech hub for Sub-Saharan Africa.
She still talk say di state don invest well for infrastructure and tech facilities inside tertiary schools, and di training go give students both book knowledge and real industry experience. Di Permanent Secretary, Mr. Adeniran Kasali, add say wetin go normally cost students and dia parents plenty money, di government don make am free of charge. He assure say expert trainers don already set to guide di students so dem fit become self-reliant and globally ready. Di training go start Saturday, November 1, 2025, for LASU, Ojo, and Lagos State Health Tech, Yaba, and e go gather over 500 students from different schools. Di grand finale go happen for Adeyemi-Bero Hall, Alausa Secretariat, as di program show how Sanwo-Olu government dey serious to end graduate unemployment and make Lagos di center of digital learning and entrepreneurship for Nigeria and beyond.
Written by: News Editor 1
Babajide Sanwo-Olu initiatives Lagos digital skills program Lagos entrepreneurship training
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025