Lagos

Lagos Go Buy 100 New Trucks to Keep City Clean

todayDecember 5, 2025 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State Gorment don yarn say dem go buy 100 new CNG compactor trucks next year as part of 10-year plan to make city clean.

LAWMA Managing Director, Muyiwa Gbadegesin, talk say dem go dey add 200–250 new trucks every year until dem reach 2,000 1,000 for daily work, 1,000 for backup.

E add say dis long-term plan go join state-wide household billing system, wey go help manage sanitation better.

Na so Lagos dey ginger to stay clean, improve waste collection, and handle trash wahala sharp-sharp.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app