Lagos

Lagos Goment Warns Say Adulterated Palm Oil Full Market

todaySeptember 21, 2026 1

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Lagos State Gornment don warn pipo say contaminated palm oil dey enter markets across di state, as LASCOPA urge consumers make dem dey careful.

Dr Nurah Oseni from Auchi Polytechnic explain for Lagos State Food Safety Conference say some sellers dey use harmful dyes, recycled cooking oil and other adulterants to change di colour and quality of palm oil.

Oseni advise consumers say make dem no depend only on colour to judge palm oil, as she call for stronger monitoring and better ways to detect adulteration.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds