Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment, joinbodi with State Primary Health Care Board, on Tuesday don announce oh, say dem go carry out Measles–Rubella (MR) vaccination campaign to fight vaccine-preventable sickness for di state.
Dem say di ogbonge campaign go run from January 20 to January 31 across Lagos, covering schools, religious centres, primary healthcare centres and markets, and e go target pikin wey age dey between nine and 14 years.
Speaking during one-day media tuk tuk for Lagos, State Immunisation Programme Coordinator, Dr Matthew Akinpelu, explain say di vaccination na to reduce measles and rubella infection and close immunity gap for pikin wey never collect rubella vaccine.
According to Akinpelu, measles and rubella dey spread fast and dey very dangerous, especially for children and pregnant women, as about 10,000 pikin dey born every year with Congenital Rubella Syndrome for Nigeria.
Written by: News Author
Lagos Health News LAGOS STATE GOVERNMENT Measles-Rubella Vaccine
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025