By: Esther Ayoola
Nor be small tin oh, Data from Lagos State Ministry of Health dey show say, about six million residents dey live with hypertension, but most of dem no sabi say dem get di sickness.
Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, tuk dis one yesterday for leadership tuk, tuk, wey Lagos State Primary Health Care Board organize with partners like Nigeria Health Watch.
Di mata gather top gornment officials, health administrators and local council leaders to check Lagos primary healthcare system and find how dem go take hellep pipo for di state.
Abayomi warn oh dat pipo wey well for Lagos nor plenty oh. hypertension, diabetes and obesity everywia.Â