Lagos State Gornment say e dey renew im commitment to make sure say, schools dey safe for childrensis and protect dem from abuse, fear and other forms of jaguda.
Na di Commissioner for Lagos State Ministry of Basic and Secondary Education, Hon. Jamiu Tolani Alli-Balogun, tok dis one on Tuesday, September 22, saying schools suppose be places where childrensis dey feel safe, valued and protected as dem dey learn and grow.
E say teachers and other education workers get responsibility to protect children and make sure say no child experience abuse, fear or shame for school.